Pidgin Yo Mama Jokes

1.6K 88 26
                                    

Before we start, lemme confess, I love my Mumsy more than anyone else, I love her the way I no fit understand sef, I would do anything for her. And I know you all do too. So this ain't against your Mum or anybody else's Mum for that matter. It's all just innocent 'Yo momma jokes' in Pidgin English. But even if na like that, I pray my Mumsy no see this o, or else.....I'll call you from the other side.

Yo mama too short, if she snap passport her legs dey show.

She too ugly, she go strip joint, them pay her to wear her clothes back.

Yo mama fat sote when u drop am for work with im yellow rain coat people dey shout 'TAXI TAXI'.

Yo mama too fat sote her shadow dey weigh 100 pounds.

Yo mama too old wey be say her first Christmas na the first Christmas.

Yo mama head too big, na shoe horn she take dey wear face hat.  

Yo mama dumb sote she go sit on top of TV dey watch sofa.

Yo mama dumb sote na parked car hit am.

Yo mama lean sote you no need to open gate before she enter. 

Yo  mama old sote she be waiter for last super. 

Yo mama too thin she no need umbrella when rain dey fall, she go just dodge the drops.  

Yo mama big, wey be say na plus size rake dey go dip inside black paint to be her mascara.

Yo mama so mumu, she paint her head with lipstick say she dey make up her mind.

She be heavy mumu, I tell her make she buy me colored tv, she ask me 'which color?'  

Yo momma so black the water wey she take bath, dem dey use am dye cloth.

Funny Random Things That Only Nigerians Will Understand(ProjectNigeriaUC2017)Where stories live. Discover now