WHO I GO FEAR?

11 2 0
                                    

Who I go fear?

Shey na government wey say dem go protect us,
Or the bible wey the world carry for head?
Or make I reject the Holy Spirit?

Who I go fear?

The lawyer wey dem hire to fight for the oppressed
Or the sweet words wey dey commot
For pastors mouth on Sunday?

Who I go fear?

People wey say Jesus na white man,
And na heaven sure pass,
Or make I trust our leaders?
Na dem own worst pass.

Who I go fear?

My own country wey don betray me
And dem no show me love,
Or the same sunday school teacher
Wey steal our innocence from our body?

Who I go fear?

My self, wey too know book
Or na because say I no dey fear anybody

Who I go fear?

NEKU'S TALE Where stories live. Discover now