Sojas

18 13 0
                                    


“Oga Soja, una no fit to see anything do?” I hear Papa as hin dey tok to di Soja man—our new Soja neighbour. Papa teh me say na government send Soja man kom hia so, di government dey recruit new Sojas for our area, dem say di new Sojas muss to fight di war. E fit be why our Soja neighbour rent house for hia, maybe di government been dey send dem kom watch over us too. Papa don hear of di bombing wey happen for almost our house but Fiona and me nor really teh Papa di whole truth—truth say, we go outside wen we suppose no go.

“We go take fast actions Sa, I go forward dis to di head of office too.”

“Thank you Oga Soja, na God go help me bless you.” I see Papa shake, our Soja neighbour hand

OGA SOJA Where stories live. Discover now